I totally gree wetin u dey talk so because wetin u talk na the honest true but for me, I no think say wetin people dey talk no really matter, because say everybody get right to choose who dey want dey with, as na one of human rights but bible no gree approved that kind of marriage or companionship, if we check the bible well, e say one man and one woman, not man and man or woman and woman, so that means it's a taboo for us to go against the rules of God but we no fit judge because we no be God, everything dey God hand and na e go decide how e go carry judge such people but make we carry am for mind, say anything wey we know say e good mk we do am.
Regarding this issues of Lesbian's and gay not be now the thing start e don tey when the thing start but make we reference am go back then is it good at that time "NO" because Allah Almighty forbid it, so i see am say na work of devil which we have to run our from it, Allah loves us and anything he tell us not to do na for our own favours be dat, make e no come give any dangerous disease when fit kill us. Let humans right of a thing no de push us like that ooo because everybody get religion and na that religion go guide us, i think person wey no get religion na im the follow human rights, i no take human rights bad ooo but each religion get their human rights wey det dey follow. Westerners are try to mislead us to believe in their so called human rights which the ideology they have is different from our thinking.