Hi community,
Making some research this morning i had to understand that Nigeria is among the top countries that trade Bitcoin most, only behind, India, China and the United States of America, this is a nice one, because even with the current unemployment rate in our country the youths have found a way to make money legally without settling down for crimes and illegal activities, that shows that as a country we take full advantage of technology and make profit out of it, it's a nice one let's continue the good work of making our fatherland proud.
Even when our government wan disgrace us, we still no gree for them.
I no go lie you bitcoin don help plenty youth for dis country ooo, because even dis forum wey we Dey, if no be for bitcoin, forum for no even Dey self, because na person wey create bitcoin create this forum also. I sabi plenty people wey be say right from school na him dem don start crypto, and na Wetin dem use sponsor themselves till dem finish school, and na Wetin dem Dey do uptill now be that. If no be for crypto, I Dey sure say the crime rate for dis country for don increase pass as e Dey currently, because some people wey Dey do crypto now, if to say crypto no Dey, some of them na yahoo dem go Dey do.
With the way crypto Dey now, I no Dey sure say government fit do anything to stop us from using it, people go definitely Dey look for alternative wey dem go Dey use, because where people Dey see food chop from, dem wan block am, and Dey no provide job for people.