Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Do Airdrop tel buy bitcon
by
Fiasem20
on 24/05/2024, 20:39:44 UTC
For here we don already know why e good to invest in bitcon already but bcos of economy matter, we nor fit invest in bitcon as we want but thank God Airdrop and bounties don dey pay well again. We don see people wey dey cash out welll from them well well especially from the latest one wey be Not  coin, people cash out well from m and other recent one like Ice and the others.

My advice be say make we nor dull put for Airdrop matter, do m wen the money come buy bitcon, nor go dey HODL Airdrop coins bcos most times the developers na to make money na concern them and so once the coin don dey listed they go sell wey them still cash out. Just take your cash out tel invest in bitcon so that go fit quickly reach your accumilation goal.

Also remember the risk wey dey Airdrop, use separate wallet for Airdrop, observe well before you do anyone bcos some na waste of time.
Omo the hype on airdrop and bounties choke.I just dey for huz na mah bro call me say you don hear say Notcoin don pay,and na dis same Notcoin wey most people think say na scam, Notcoin don create wave for the crypto space say airdrop na legit but the thing be say the airdrop con plenty like say na sand so with that how person wan take dictate which one be scam or not.Now na Tapswap, people don dey predict say Tapswap go give positive cashout no be small thing oh na tapping levels haha....... nobody wan dey left out.Since we no dey new to the cyptro space wan gat know say the wallet wey our coins wey get potential like bitcoin suppose dey different from these new projects.