Hi community,
Making some research this morning i had to understand that Nigeria is among the top countries that trade Bitcoin most, only behind, India, China and the United States of America, this is a nice one, because even with the current unemployment rate in our country the youths have found a way to make money legally without settling down for crimes and illegal activities, that shows that as a country we take full advantage of technology and make profit out of it, it's a nice one let's continue the good work of making our fatherland proud.
Even when our government wan disgrace us, we still no gree for them.
The innovation and d kind of profit wey pipo dey see from crypto na some tin wey b say no go even make any body wan leave am no mata how our government wan stop us from utilizing the potential wey full d crypto space wey be say e dey put food for some pipo table on d daily biases and the intresting thing be say d more wey our government fey try fight d crypto mata na d more wey b say d tin dey dey popular as new projects dey come up daily and pipo jus dey use am dey cash out almost everyday and for some e don turn work of which if dem leave am e goo wori dem so i think our government no dey try sef because dem sef no go fit provide jobs for every body wey dey do crypto wey dem want to stop so somehow dis tin dey actually help dem dey make up for dat gap but dem no wan recognize am and na wetin dey wori dem b dat.
if dem actually get to succeed with their bid to stop crypto dem go actually suffer am because crime rate go increase no b lie because no b everybody go dey employable by d government so dem go just result to crime because even now wey be say some pipo still dey do crypto and other things wey dey give dem money, crime still dey so definitely e go actually worse make dem just allow Nigerians utilize tech well so in d long run e go follow help d country economy as well.