With the way scammer they now must people no dey like carry there ear take hear Bitcoin because them dey fill say na scam
Na before matter be that ooo, now people no Dey call bitcoin scam ooo, for my side if people even know say person Dey into crypto, dem go wan come close to the person make dem also learn. I know talk say Wetin u Dey talk na lie ooo, but depending on the location wey you Dey, maybe for your side people never still too Dey expose to bitcoin na why dem Dey tag am as scam be that.
But for my side everybody wan invest for crypto now, the only thing wey Dey stop people now na money, country too hard now, person wey never get money chop food no fit go put money for crypto now, na why now wey mining and airdrop Dey, everybody Dey rush am because no be say na money you go put.