For here we don already know why e good to invest in bitcon already but bcos of economy matter, we nor fit invest in bitcon as we want but thank God Airdrop and bounties don dey pay well again. We don see people wey dey cash out welll from them well well especially from the latest one wey be Not coin, people cash out well from m and other recent one like Ice and the others.
My advice be say make we nor dull put for Airdrop matter, do m wen the money come buy bitcon, nor go dey HODL Airdrop coins bcos most times the developers na to make money na concern them and so once the coin don dey listed they go sell wey them still cash out. Just take your cash out tel invest in bitcon so that go fit quickly reach your accumilation goal.
Also remember the risk wey dey Airdrop, use separate wallet for Airdrop, observe well before you do anyone bcos some na waste of time.
Before now, airdrop and bounty sef been dey pay well well even for this forum because I know boys and men wey don cash out massively from this stuffs but as the crypto space dey big everyday na so so new project wey no get head sef come dey full am and na why the rate of scam airdrop averaging the original ones dem don really pass be careful and na why most person even hang leg come give up on am. But your advice of participation now as notcoin and some others pay no be bad idea at all but the thing be say airdrop na airdrop and the huge possiblities of all this project ending up as scams sef e too big so e better pass make person even channel all those energy find another work wey dey pay well then put am for DCA method to store coin wey get value instead.
Na true you dey yan here like this oo, me self I know plenty people wey don collect woto woto for bounty and airdrop even this year self most of my guys collect waiting no good for ice and even notcoin and this notcoin matter really trend well well e come make some people wey been no get interest for cryptocurrency or airdrop stuff get interest. right now almost everywhere na airdrop airdrop though e good to dey do am oo cause you no know the one wey go pay and as you dey do am make you no put your hope and trust there cause e fit work out and e fit no work and as plenty people dey dive into airdrop na so scammers dey find strategy wey them go take loot money from people and those people wey dey tap without crypto knowledge ( those people wey join because of notcoin news) na them I dey pity pass cause dey go use their head so easily.