Original Topic: Don’t be lured by the promises of easy money!Author:Pmalek
D way Bitcoin money just dey go up,rats wey dey for inside poto-poto(sewage)don comot for d place wey dey hide dey look for person wey dey go bite.
But this rat gon gon no just know d crumbs of bread or na your money e dey look for oh no. E wan mey you get problem with law, e wan mey you b him scape goat. Na him b the rat wey worst past for inside d hole wey dark past.
for una wey browse d
Services section, E fit b say una don notice one kind 419 wey dey around.
I no wan help 419 people put links for him threads, and I go wan tell other members wey talk for my thread mey they no do so.
The thread sef get issues with rule #17:
17. Dem no wan mey dey dey do Buying and selling of dose stuffs wey dey illegal for buyers or sellers countri. .
Unofficial rulesHow 419 dey take work? D person wey dey do 419 go promise d person wey e wan do 419 say him go make am become rich -fast. him no go ask am for any money, and him no go do any work.
D only thing wey him go do na just to give am access to him
blockchain.com account. Him go add some Bitcoin to your account and later com give you back your account plenty with Bitcoin.
I know wetin you dey think. How this com be 419? I get free Bitcoin and i no do anything. any time wey you see offer wey be like that, try ask yourself d following questions:
1. If to say e easy, why he no do am by himself
2. Why him come dey look for my account?
3. Why e no come make him family, friends and everyone wey him know rich?
4. Wetin make me one kind wey him come dey look for my help and my account?
If you want know 419 person, you no need too much training. D only thing wey you need na just small common sense. Dey honest! you dey one kind?
You get one kind skills wey be say na only u get am and wey be say this person fit use HELP you make big amount of money?
If you dey honest to yourself, your answer na negative, and you feel dis smell small, like 419, you dey correct side.
I thank another person wey dey forum, wey follow this 419 talk, now we know wetin him dey plan. wetin 419 no mention for him topic be say him dey use
credit cards wey dey thief to buy Bitcoin with your account! How dat go sound for fast small earner?
Na wetin make him want your account
Na wetin make you one kind.Na you be d correct person wey him go fit catch and come be him helper wey him go do that work with for credit card 419. If your account dey connected to your name wey you do your KYC, you don do credit card 419 for law side.Open your two eyes and no believe everything wey you read!