Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: If you do this can you hold bitcoin?
by
CryptopreneurBrainboss
on 21/06/2024, 23:33:25 UTC
I know there are some newbie thinking what to do to hold bitcoin, first, if you save money in your bank account, you can use the money to buy bitcoins and hold which is the wish of many holders in the community,

You fit still buy Bitcoin directly anytime wey you get money and they hodl am for your address (inside custodial wallet). Saving in banks no sure again because when you wan collect the money, e go dun reduce. Different bank charges go dey devalue the amount wey you keep with them. As far say the money fit buy Bitcoin well (after buying still pay for service and transaction fees), you am buy Bitcoin. No be must to buy from exchange, you fit do P2P exchange and get the Bitcoin for your wallet.

Quote
secondly, if you grow your bitcointalk.org account to full member above and apply for signature campaign, and if you are accepted in that campaign, you can hold bitcoin which is the easiest way many people use  to hold bitcoin

No lie there but no over put hope as signature no dey guaranteed, say you build your account to full member and above no means say signature slots dey wait for you. This part of the forum dey so congested wey be say you fit grow your account finish but to get campaign fit be wahala. Plenty account dey out of work and if na only here you hope dey e go hard to dey keep up oh for your investments plans dem.[/quote]

Quote
thirdly, you can sell you land and property to hold bitcoin, which I have see someone on television some years ago, sharing his wealth secret to people, how he sold the land he inherited from his father to buy bitcoins and hold for long term before he sold to make money that turned him to millionaires in the country. What are the other ways people can hold bitcoin.

Bitcoin na actually the trending Investment and na where trend dey na that place dey get better returns fast. Land investment no bad but you fit buy that Bitcoin, make profits and rebuy your land back although make this investment no be your last hope because e get times wey market fit fall to the extend you fit dey tempted to sell as you put all your hopes for the investment. The koko be say anything wey you dey do, make you dey get other options and no make am your only hope.