The difference is clear, investing what you can afford is used when you are interested in building future wealth while investing what you can afford to lose applies to cases where you just want a short-term profit and it mostly happens when you're trying things out.
You try but no dey take things out of the context wey e dey, in both scenarios they're saying the same thing but using different words to pass out their information. Reason the discussion wey dem dey get before dem say invest what you can afford to lose. Shey you go just invest to throw away money, even the person wey dey invest for ponzi scheme dey get hope say him go make better returns. Just know the whole internet can go down one day self (but we no dey pray for am) and we no go know wetin happen same thing fit happen to Bitcoin.
Your investments in landed properties and other valuable assets can still be a waste so as you dey invest make you no dey guaranteed yourself say your money dey alright. People dey buy land finish and enter court problem (losing
money and still lose the land). Anything wey you dey invest inside no put money wey pass you, no put money wey you no go fit take the loss if you lose am. If you no fit takehyhe lose you go commit suicide oh. The rate of suicide they increase and na because people dey do pass themselves. They believe say everything dey under control but when wahala come dem no fit take am because dem dun go put money wey dem fit avoid before because everything dey go well for that time but forget about when times go go south. Invest what you can avoid to late then lose not what you can afford to buy using present circumstances.