Omo you self ehh how you come dey reason to go sell person land wey him don try acquire to buy bitcoin like you dey reason well at all?
My brother e never reach for abuse or derogatory question. Op just added selling of land at the extreme of how person fit still hodl btc and he gave an example of that. However self, that no dey impossible because people dey different and get different believe on btc. Afterall na person still take him btc take exchange for common pizza, that person no believe say btc go rise reach as e dey today now. So likewise, person wey believe say btc go rise pass the value of him land in the near future fit still sell to buy btc. I'm sure some people for sell wetin dem get to take buy btc if dem know say the price go skyrocket reach as e dey so. Therefore, it is a view which is not impossible only say the price of btc don dey too high for that kind of adventure.