Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Consider all this before starting your Bitcoin journey.
by
CryptopreneurBrainboss
on 22/06/2024, 14:34:35 UTC
4. Look for a teacher or mentor. As person way they start newly you need to get person way go they guide you on how to carry on your investment. You need to consult person with more higher experience about cryptocurrency.

You go wait first make you learn well before you begin dey teach other people make you no go mislead them. You do not technically need a mentor, teacher or anything you wan call them. I no dey talk say dem no good but e no dey necessary. If you dey in the midst of better company like this forum like this you're very good to go because advice and guidance go dey come from everywhere and you no go need personal mentor. When people dey find people to mentor them. I dey always tell them say make them reason the first people dem wey join the industry whether them being get mentors.

Quote
5. Secure your Bitcoin. Make sure say you protect your Bitcoin very well, you need to use wallet way you know say they very good like trust wallet, Binance e.t.c and make sure say you keep your password only to yourself.

Trust wallet isn't one of the best wallets out there, it is very convenient and might be a good starting wallet for newbies but e no suppose be wallet wey you go dey use hold Bitcoin because e dey closed source. Binance been dun buy am and Binance na centralized business dem dey sabi practice. Binance na exchange and no be wallet to use dey keep your Bitcoin. Recommended wallets are hardware wallets wey be non constodial and open source. You fit still use Electrum wey dun dey the industry for a very long while and dem never fuck up.