Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Be cautious of your P2P trading in Bybit
by
Kelward
on 28/06/2024, 13:17:44 UTC
Please when carry out a p2p transaction in bybit, always check reviews and numbers of transactions of the vendor in other to verify his operations and worthiness.

Thanks for sharing this information with us, with di way wey our government agencies take de put eyes for crypto matters de find who dem go take make scapegoats no good at all. I hope say make our government sort out dem issues with exchanges so that people wey de do genuine transactions go get peace of mind, make government go after criminals and leave ordinary Nigerians wey de find dem daily bread for exchanges.

For dis crypto industry reputation de very important because scam plenty, so na correct talk you yan, e de important to verify di review and numbers of transactions of any vendor before you go run p2p transactions with am. Aldo e go affect new and genuine vendors wey de for exchanges, unto say dem reviews and transactions no go plenty but to be on di safer side na to run di matter with vendors wey don gain reputation.