Bitcoin can only reduce crime rate in the society for the ones who knows how to read and write because someone who don't go to school can't just wake up one morning and start talking about Bitcoin. The important thing is anything that has positive also have negative... Bitcoin can reduce crime and can not also reduce crime.
Though you correct sha, as people need education to be able to understand and thrive in crypto but I just wan ask you weda, people wey no go school, no dey use bank? For our country both the educated and uneducated persons dey fit use phone, sometime our mama dem go call is to help dem dail person number or save number wey dem fit dey call. And small small dem fit do am by them selves. But talking about Bitcoin even if then no fit make trades and transactions by themselves dem fit call one of their trusted children to help dem dey make transactions. Majority of persons in this world are getting digitalized but the few wey no fit meet up, no problem, because no matter how people adopt reach, no be everybody go fit hold Bitcoin, some by choice while others Na by restriction.
Inasmuch as Bitcoin don stay Tay for the world, we no fit overlook the fact say it's still relatively a new technology, compared to other technologies that have been and still in existence, and it'll still take several years for Bitcoin to gain mass adoption, although millions of people around the globe are actively involved in the cryptocurrency business, but compared to the overall population of the world, you'l go know say plenty people never even dey involved for Bitcoin, that is to say that bitcoin still need more time to reach that level of mass adoption wey traditional banking systems don attain.
So when time reach wey Bitcoin go gain such popularity for this world, both old folks them go follow use am too, but for now, the thing go too dey complex for them, even when you explain am for them, them fit talk say na scam self.