I am a newbies here, am sorry I will be asking series of question to broaden my knowledge on how to go about my posting in this forum. in this platform are there other skills to learn to improve ones knowledge? Is it possible to bring health related topics for discussion in this forum?
Forum wey you enter na about bitcoin, so Wetin u self suppose Dey expect na things about bitcoin. Seriously me I go tell you say if na about bitcoin or other cryptocurrencies na him you wan learn about, then na d right place for you be dis, but if you get other things wey you wan learn, then e better make you just hustle for another platform because you no go really get those informations here.
If you carry Health related issues come dis local board, the moderator go help you move am go off topic which people Dey hardly visit. If you wan talk about Health issues, then e better make you find another platform go.