Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: No save money inside Bitcoin for short term use because of price dip
by
CryptopreneurBrainboss
on 04/07/2024, 23:56:45 UTC
But I don notice say many newbies wey I know for Bitcoin matter no get knowledge about how e de work, dem de buy Bitcoin with money wey dem wan use on the short term because dem hear say e de profitable. I believe say na only wen we enter bull run proper wey Bitcoin price go de surge steadily na im investors fit to take chances to invest money for short term profits.

Misconception say wetin dey happen here na only gambling and ponzi scheme na wetin make people dey believe say dem fit invest money today and become dangote tomorrow. We dey believe everything wey we dey see for internet say this person make like this amount and like that and we go just think say na so e be. Sometimes self I no dey blame the newbies  again because na the lies wey dem tell them to make dem use their referral code register for some of this exchange na wetin make them dey believe say the industry na where to not take am serious and just behave like say dem dey play bet9ja.

Quote
preferably do DCA method and no plan to sale am on the short term. Na my advice to newbie investors.

You no fit dey wrong with this method, e sweet pass when you get work and you dey get salary. Even though you no get salary work self but if you dey receive money and you fit plan yourself well on how you go dey run the monthly investment, before you know you dun put better money for the market than to they wait make you get better block to use buy one time. DCA makes investing in Bitcoin simple and more profiting, just know that one and sha only dey invest money wey no go too much for you if you lose am.