Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user
Re: Is cyber crime the last resort of the struggling Nigerians
by
Juicyhome
on 06/07/2024, 12:39:56 UTC
⭐ Merited by Igebotz (2)
I was going through the social media and came across this news about the Economic and Financial Crime Commission Chairman, Olukoyede saying that 7 out of 10 Nigerian students are involved in cyber crime. This is not something to be proud of because it means that 70% of Nigerian students are into cyber crime which I think it is not true entirely when deeper analysis is done about it.

We know that the rate of cyber crime within Nigerians and especially student is increasing but I don’t think it has gotten to that level that he said already. We know this moment are hard times and the economy is not friendly to everyone. Settling for cyber fraud shouldn’t be the last resort for any Nigerian. How can this be averted in the country and what are the possible solutions to stop students from involving in such criminal activities.



https://www.instagram.com/p/C0gaCP0s5MJ/?igshid=MzRlODBiNWFlZA==




Di reason for dis increase for Naija dey always tok say na because of say di values wey dey society don dey spoil, because of di bad influence wey politicians wey dey chop money from government take do dia own private tin. Di fact say pesin no need any special qualification to enter politics mean say pesin fit become rich overnight if e enter public office. Dis get-rich-quick syndrome dey influence young people wella as dem dey try make money by all means, even if na through crime. But e get other things wey dey cause dis matter; poverty, unemployment and inequality rates dey increase. Cybercrime dey look attractive to many people because di chance say dem go arrest you dey low, and many of dis criminals get di physical and technical resources.
people they always blame the government for rubbish our youths  dey do, i know say the government dey fuck up, but make e nor make u indulge in crime wey go give bad image to our counrty, as politicians don spoil am make we no join dem spoil am more make we do our best to correct the wrong of our bad  leaders. going into cyber crime is not the best things to do, e bad say yahoo  yahoo is normal in the country today. e don reach secondary school. the future of the country, so how the country wan take beta na. weytin the efcc boss talk na true, if u visit the Efcc cell na young guys full, guys of 14-17. so bad for the future of our country, we need they try speak against it. if e go reduce small bcos the cyber crime dey increase everyday. And some parents dey support am, dem no dey question their children wey dey bring money and car to the house again when u know say dey no dey do anything to get the car and money.

make we try avoid cyber crime and go for legit stuff wey go put food on our table, crime no dey pay, instead e go destroy ur future, bcos Efcc no dey sleep. dem go catch u one day and u go lose all ur properties to them.