Nobody know exactly wetin Bitcoin price go be in di next 24 hours, weda e go pump or dump, na only speculations and predictions we fit to do. Dat na why newbies need to understand say e no de advisable to invest in Bitcoin on a short timeframe because di price fit to dip wen dem wan use di money. Invest di amount wey you fit to put aside, preferably do DCA method and no plan to sale am on the short term. Na my advice to newbie investors.
No be only newbies dey invest in bitcoin for short term, plenty experienced people na trader when dey buy bitcoin to sell and make fast profit. Although e good to advise newbies to put attention for long term hodl rather than looking for quick profit because na this one go help them more. The experience people don already learn trading and plenty other ways of earning profit from bitcoin wey the newbies them never learn so them fit dey make mistake untop am come lose their money.
Many of us wey don trade before know as we lose that time and if to say person give us the orientation of holding from that time till now, we for get better bag of bitcoin now. Even if person wan trade or buy for short time, e good make the person make another arrangement to take hodl. The two fit dey go on at the same time.
E no de advisable for newbies to seek for fast profit inside Bitcoin investment, make dem just de hodl am and then begin to de learn about trading if na quick profit dem need. E de better to comot mind for quick profit inside Bitcoin investment because e de volatile and price fit to pump and dump at anytime wey fit no favor di holder. Di answer to quick profit na for inside trading but e carry im own bag of risks, as you de find quick profit quick lose fit to happen. Crypto trading na for experienced traders wey don get practical experience over a long period of time, if newbies rush enter am based on the shill for social media say na fast way to make money, most likely dem go lose all dem money inside.