Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Bitcoin Na For All: But can the 63% Wallowing in Poverty invest in bitcoin?
by
Derek jnr2001
on 08/07/2024, 07:22:31 UTC
Actually every body fit Investment in bitcoin as Long as you get the capital to start up with, but for those who barely feed you no go expect those kind of people to invest in bitcoin when dem still dey look for food to chop. However bitcoin investment na for those people who don chop belle full so that incase of anything happen in the market in no fit affect you in anyway, just imagine those people way still dey struggle on how dem go take survive probably after struggling dem come use the money way them suppose to take hold body come go invest am in bitcoin e come happen say they  experience lose in the market.

You know how in go take pain Dem for body at this point him go begin dey regret say assume mean say him know say him for use the money go buy some food stuffs, this thinking go reach one full month sometimes self in go past one full month dem go still dey think about the lose, though bitcoin na very good asset that can profit us in the future but no go put body for bitcoin investment when you never chop well.