Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: No save money inside Bitcoin for short term use because of price dip
by
Derek jnr2001
on 08/07/2024, 08:16:52 UTC
Bitcoin na one of di best investments wey anybody fit to enter but many newbies no know say e de better to hodl am for long term. Unto say Bitcoin de volatile dat na why e de advisable to hodl am for long term because na store of value wey de take long term to reach new ATH price and give better ROI.

But I don notice say many newbies wey I know for Bitcoin matter no get knowledge about how e de work, dem de buy Bitcoin with money wey dem wan use on the short term because dem hear say e de profitable. I believe say na only wen we enter bull run proper wey Bitcoin price go de surge steadily na im investors fit to take chances to invest money for short term profits.

Nobody know exactly wetin Bitcoin price go be in di next 24 hours, weda e go pump or dump, na only speculations and predictions we fit to do. Dat na why newbies need to understand say e no de advisable to invest in Bitcoin on a short timeframe because di price fit to dip wen dem wan use di money. Invest di amount wey you fit to put aside, preferably do DCA method and no plan to sale am on the short term. Na my advice to newbie investors.

Waiting you talk na true op as a newbie that I'm I don come to notice that this bitcoin investment no be waiting fit profit person for Short term rather na waiting go profit us in the future, most of my follow newbies they always mistake bitcoin for altcoin and memecoin way fit profit you within a short term.however  most newbie self dey see bitcoin investment as get rich quick scheme, reason is because dey no wan settle down to learn how bitcoin investment works before Dem go think of making investment.  you know if you go involve yourself in waiting you know nothing about definitely you go dey see am in different ways that is why I wan just settle down to learn how bitcoin investment works before I go start to they think of making any investment plan, As long as say money dey involved person no need to Rush make we no go experience lose in the market.