Bitcoin na one of di best investments wey anybody fit to enter but many newbies no know say e de better to hodl am for long term. Unto say Bitcoin de volatile dat na why e de advisable to hodl am for long term because na store of value wey de take long term to reach new ATH price and give better ROI.
For this recent dip, my niggas laugh me wetin no good as them see the way the price dey go down with full speed, them even dey pressure me make I sell because according to them, say I don enter one chance, but me I no reason am as I know before say na so em dey be. I even try explain give them say all these things suppose come before bull run go start, but the more I dey straighten them, the more them dey reason am say my head no correct, so I just comot mind for them as I dey sure say them go praise me in the nearest future when the bull run start.
But I don notice say many newbies wey I know for Bitcoin matter no get knowledge about how e de work, dem de buy Bitcoin with money wey dem wan use on the short term because dem hear say e de profitable. I believe say na only wen we enter bull run proper wey Bitcoin price go de surge steadily na im investors fit to take chances to invest money for short term profits.
Na very bad orientation be that, them no suppose buy bitcoin with money wey them go need anytime soon as no one know exactly when bullrun go come, so them fit even sell in loss when needs hook them for neck.
Invest di amount wey you fit to put aside, preferably do DCA method and no plan to sale am on the short term. Na my advice to newbie investors.
Na this advice legit pass. DCA method go save you pressure as you dey buy am for slow and steady means. You just need get your target, so you go dey purchase small small until you reach am.