and we can see that it where technology is heading, what do you think will become of it in the future, won't they ban it totally? And people who are moderators and crypto ambassadors, tech guys developers, how will they survive, can people coming behind still make crypto a career.
Omo make you no discourage yourself oo about crypto matter for naija or any other place for the world self. In fact if you want to learn anything concerning crypto or blockchain make you better put your body and soul inside am oo and learn am well well. You don already talk am say na technology the world dey head to so nothing fit stop that frequency and wave now. Government no fit stop am because people go still use VPN access wetin dem want access, na only restrictions dem fit do and na how long dem fit hold on to that self. The mining stuff wey dey go on self wey dey make telegram dey relevant now self go tell you say more people don jump in. Even naija government don dey reconsider how dem dey run follow exchange owners and agents because dem don see say dem no fit stop am like dem dey feel say na that one dey cause Naira to fall. Dem self don see say no ojoro for there.