Bitcoin na one of di best investments wey anybody fit to enter but many newbies no know say e de better to hodl am for long term. Unto say Bitcoin de volatile dat na why e de advisable to hodl am for long term because na store of value wey de take long term to reach new ATH price and give better ROI.
If anybody get money wey him go use within a short period of time, then e better make d person no even put am for bitcoin because e fit no end well. E just better make we leave money wey we wan use for naira inside our bank, or make we leave am for stable coin, but no put am for bitcoin. E fit be say na when you go wan commot d money na him bitcoin go dump, the price wey you go sell d bitcoin go don dump by then, so you will be selling at loss. If you are not investing for long term, then you have to be very careful when investing.
But I don notice say many newbies wey I know for Bitcoin matter no get knowledge about how e de work, dem de buy Bitcoin with money wey dem wan use on the short term because dem hear say e de profitable.
Na orientation most newbies Dey lack, most of them Dey reason say bitcoin na get rich quick scheme, dem believe say if dem put money, within a short period of time, their money go don grow well and things don’t really work like that, and na y e Dey easy to scam newbies.