Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: No save money inside Bitcoin for short term use because of price dip
by
HajiBagi
on 10/07/2024, 20:02:51 UTC
Bitcoin na one of di best investments wey anybody fit to enter but many newbies no know say e de better to hodl am for long term. Unto say Bitcoin de volatile dat na why e de advisable to hodl am for long term because na store of value wey de take long term to reach new ATH price and give better ROI.

But I don notice say many newbies wey I know for Bitcoin matter no get knowledge about how e de work, dem de buy Bitcoin with money wey dem wan use on the short term because dem hear say e de profitable. I believe say na only wen we enter bull run proper wey Bitcoin price go de surge steadily na im investors fit to take chances to invest money for short term profits.

Nobody know exactly wetin Bitcoin price go be in di next 24 hours, weda e go pump or dump, na only speculations and predictions we fit to do. Dat na why newbies need to understand say e no de advisable to invest in Bitcoin on a short timeframe because di price fit to dip wen dem wan use di money. Invest di amount wey you fit to put aside, preferably do DCA method and no plan to sale am on the short term. Na my advice to newbie investors.

Any newbie wey go invest for bitcoin and he or she no understand am before investing na their problem because everything needs to be known and understand before taking any decision to invest, make any newbie no go think say because bitcoin they bring profit go invest money wey him go use chop invest in bitcoin because in the end you fit surprise with the result wey you no go like, bitcoin na better invest but e get as e be and everyone need to study am very well before investing in it.

I no mean say make anybody no invest in bitcoin oh, what I’m trying to say is that make sure say you don understand waiting you wan go chook hand for make you no go Dey spoil bitcoin name for outside because say e no favor you, make sure say you Dey capable of investing and as a newbie to start investing I will advise you to invest any amount wey you fit hold for a long time to avoid things wey no go good for you, just make sure say you know much about bitcoin before you carry your two hands go invest.