Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 8 from 4 users
Re: No save money inside Bitcoin for short term use because of price dip
by
rachael9385
on 10/07/2024, 20:21:31 UTC
⭐ Merited by Mate2237 (3) ,Odohu (2) ,Miles2006 (2) ,Sim_card (1)
Bitcoin na one of di best investments wey anybody fit to enter but many newbies no know say e de better to hodl am for long term. Unto say Bitcoin de volatile dat na why e de advisable to hodl am for long term because na store of value wey de take long term to reach new ATH price and give better ROI.

But I don notice say many newbies wey I know for Bitcoin matter no get knowledge about how e de work, dem de buy Bitcoin with money wey dem wan use on the short term because dem hear say e de profitable. I believe say na only wen we enter bull run proper wey Bitcoin price go de surge steadily na im investors fit to take chances to invest money for short term profits.

Nobody know exactly wetin Bitcoin price go be in di next 24 hours, weda e go pump or dump, na only speculations and predictions we fit to do. Dat na why newbies need to understand say e no de advisable to invest in Bitcoin on a short timeframe because di price fit to dip wen dem wan use di money. Invest di amount wey you fit to put aside, preferably do DCA method and no plan to sale am on the short term. Na my advice to newbie investors.
We need understand say the reason why dey they answer crypto Newbie nah because say them no know anything about Bitcoin, even if say them know maybe nah just few and out of misconceptions them no know the kind of money wey them supposed to use but Bitcoin because them no get better OT.
Many of these crypto newbie nah from social media them they get their Intel  from, and me and you know say many pipo for social media just need crowd for their social media pages, so many of them no really care if the informations them dey share good or not.
E dey important to invest with the money wey we no need use for over 12 months because if we talk about only 6 months holding e fit not yield any good profits by then.