I greet una my country people. As we all know this our country condition don dey pass be careful, things done dey get out of hand. My question Na how Bitcoin fit take in any way help in making Sure the less privilege fit afford to purchase or invest in Bitcoin through any ways, since we all know the hiking level now.
To invest in Bitcoin no mean say you must get plenty money first to buy 1 Bitcoin as a whole because I know say as the price of Bitcoin high like this plenty people go dey feel say dem no go fit afford to acquire am again but e get one method wey person wey no get enough money dey use to follow am up now which dem dey call DCA, this DCA dey make everybody to take path dey buy Bitcoin small small for different time e just be like person wey dey throw akawo every week or every month and e get particular amount wey you dey throw for dat every week or month so na so dis DCA strategy be, you go dey buy Bitcoin for the same amount wey you buy am the previous time just dey go but you go make sure say you get other business or work wey you dey do so dat you no go miss to dey buy am wen the time reach and when you dey buy am small small like dat you go make sure say you keep some money wey you go dey take dey sustain yourself so dat e no go make you go sell your Bitcoin when e never mature or when you never make beta profit from am.
And if you know say you wan begin dey buy Bitcoin small small no feel say na just something wey you go invest and you begin see the profit immediately, na something wey dey take time even e fit take you so many years before you go realize enough profits so e go require you to dey very patient, you fit just dey buy am steady dey keep before you go know you don buy am for plenty quantity wey be say if you decide to sell some of am for future you go make beta profit.