I greet una my country people. As we all know this our country condition don dey pass be careful, things done dey get out of hand. My question Na how Bitcoin fit take in any way help in making Sure the less privilege fit afford to purchase or invest in Bitcoin through any ways, since we all know the hiking level now.
Go get a real job na wetin fit help the less privileges be that and not Bitcoin. You no suppose dey invest inside Bitcoin self if you no get wetin dey bring additional income come your pocket. Bitcoin is more like a capital gain kind of investment wey be say you need to sell to realize gains and when you sell you no get the Bitcoin again so no be wetin if you no get job you go dey rely on to eliminate your poverty. But if you get job, you fit dey invest inside Bitcoin with the least wey you fit afford to lose and e go multiply your capital so from there you fit dey get better rubbers to take guide. Make you know say no be Bitcoin go make you fit afford am, na you need to work to afford am. The best thing wey Bitcoin fit do na to dey give you discount and him dey do am when the market dey for correction.
Bitcoin may not be playing a direct rope to the economy of the country but their is no doubt that bitcoin is playing a good role to the economy of people that is investing in it so far. Now wey be say the economy is so bad and inflation is becoming so seriously bad with high inflation, bitcoin can be use as store of value for people and this will bring value to people life. Bitcoin is contributing to many people but it is only those that have bitcoin that knows the importance of it in this hard economy.
The economy of a county improves when people are participating more in buying and selling thereby pumping money into the economy and not hoarding it. If everybody was to stored their money it doesn't benefit the economy. Wetin you suppose talk na say after people done make gain finish from Bitcoin it improve the living lifestyle of the investors and they spend and contribute to the economy of the country. The more we get money na so we go dey buy things and e dey help market sellers and other vendors too because when you buy that woman wey dey sell for market fish and she make gain, she go but garri form another seller and the chain go just dey continue.