E no easy for this industry wey we dey so. I know say I dey follow people wey dey advice to focus on investing in Bitcoin but I know say e no go easy for many to follow because me too e no been easy for me when I start to dey invest in industry newly because while you dey get 1x for your own investment your friends dey make 10x and above for shitcoin/altcoins (e go come belike you no dey dey industry) and e go worry you to wan follow them but when you do your own, you go begin lose most times and this particular one na greed but e go some wey be say the cause na say no information was given (like dem no know at all)
I wan ask, if no be misinformation, uninformation or greed, wetin one make an investor wether newbies or veterans to invest heavily on alt or shit coin? When Bitcoin still dey in the market?
All three contributes, the misinformation go be say dem no fit make profits from Bitcoin and na wetin many people dun believe so as dem dey hear for social media from influencers. Not being informed be say no body they encourage them to invest inside Bitcoin and hodl as many of them are getting introduced to the industry through Altcoins so na their dem go advice them to invest and not Bitcoin. The greed own na wetin I explainer above, normally we no dey ever dey satisfied and we want more but end up losing the little we had.