Sometimes the news of bitcoin maybe contradictory and when hoping on positive news of bitcoin you maybe backslide,
Wetin I Dey recommend to people be say, if you wan put money for bitcoin, make sure say na for long term, so if you don buy the bitcoin, just commot your mind for that side self, any news wey happen either good or bad news, e no suppose move you, the people wey suppose Dey disturbed about the news wey Dey happen na people wey Dey trade, because any slight movement against their trade fit make dem lose money. But anybody wey wan hold, make him just buy am commot eye for that side.
because many people have thought that the price of bitcoin is now getting upright but it shock some people who hoped-for speculation of Bitcoin and believes that as people speculate on price of bitcoin that the price will be going up all through this year,
You self funny ooo, reason am well now, how bitcoin price go Dey go up through out the year without any correction happening, e no really possible now. Even if bull run start, time go come wey be say the market go red, and time go Dey wey e go green. Also the main reason why people Dey speculate this year about bitcoin pumping na because of Halving wey happen few months ago. Plenty people think say immediately halving, then bitcoin go just Dey pump, but no be so e be.
Halving wey happen dis year, bull run self fit no happen dis year, and e fit still happen, nobody Dey sure when we go see bull run, but make we just know say market na up and down.
whereas the price of bitcoin is depreciating in the market almost every day, so I don't know why bitcoin can not be depending on.
I Dey reason say you no really sabi Wetin crypto Dey about before joining, and you no really care to get more knowledge, you for no Dey talk like dis. I no see anywhere wey market depreciate like that, Wetin I Dey see na up and down, and e Dey normal for crypto.