Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Na misinformation, uninformation or greed
by
Coyster
on 27/07/2024, 23:19:04 UTC
I wan ask, if no be misinformation, uninformation or greed, wetin one make an investor wether newbies or veterans to invest heavily on alt or shit coin? When Bitcoin still dey in the market?
You know say e get as altcoin pump dey be, e fit pump very high; the same way e fit dump fast fast, na wetin make dem dey call am pump and dump. So many people wey dey buy altcoins know all these things oh, but so many of dem just dey try their luck, some people dey call investing for altcoins as gambling sev.

E better for person to buy bitcoin, i know say the price of bitcoin cost well well, but e better to buy the one wey your hand fit reach, come dey wait for realistic returns, than to buy some new coins so, dey believe say e go make you rich, meanwhile na your money you dey go lose so.