My country people good morning inside this morning, today e get thing wey I wan talk about wey we they always do wey no good for us, wey at the very end, we go start to feel regret due to say we encounter serious losses.
I wan ask, if no be misinformation, uninformation or greed, wetin one make an investor wether newbies or veterans to invest heavily on alt or shit coin? When Bitcoin still dey in the market?
I just dy reason this thing since last night because one of my guy just dy complain too me last night how him invest $500 on OBX when the price been dy $0.013 since July 2022, and up till this day, the value drop to $0.0000457, and it refused to climb back, I no even bother to ask am how much remain, but I just feel sorry for am, I only tell am say in this crypto space, make him no carry knowledge and greed play, say na lack of the right knowledge or greed nai put am inside this kind of mess in the first place, so I say make I ask my fellow brother's, apart from misinformed, uninformation or greed, wetin fit make person fuck up like this, when Bitcoin still dey?
Good morning my naija people actually this matter of uninformed and greed go deal with you seriously when it comes to crypto among others Bitcoin is still one of the best to invest on. You wen dey put money for new project with misinformation you are just been used to added to the liquidity pool you maybe rug pool only if you are smart enough when u know wen to stop. Be well informed, educative and always be updated about wetin dey sup for the market.