The list plenty but make we Sha talk of the disadvantage wey e fit cos l, ike
Money laundering,
Inequality : Bitcoin fit the benefit people wey they technically savvy, people wey get money to invest and Nigeria wey I know all of this fit still resolve to corruption..
So my country people how una see this matter?
Everything get good and bad sides but when the good better pass the bad, you suppose just do the thing as you no fit stop something from having a bad side. Make we look at some of the disadvantages wey you talk, Money laundering no be wetin we suppose dey tie to only use of Bitcoin (when it gets adopted) because fiats na the highest medium of exchange wey dey involved in money laughing as cash is more untraceable than Bitcoin. If you see cash, you no fit talk where e dey come from but Bitcoin can be traced when there's no mixing involved. So the problem of money laundering no be wetin we fit solve as even the most sophisticated countries are guilty of money laundering.
Inequality how? Dem hodl you make you no dey digitally conscious. Nigerians dey adapt quick nobi here we dey when dem bring POS, debit cards, Phone etc and we all adapt. If dem make Bitcoin our legal tender we go still adapt. No be national anthem them dey change everyday and we dey adapt so. If e go make the country better make dem bring am and we go adapt but the truth of the matters be say just adopting Bitcoin isn't going to solve our problems. Our problems big pass Bitcoin as e dey in our roots and beliefs. We need more of education so we get more enlighten and fight the corruption from wetin wey dey the country.