I wan ask, if no be misinformation, uninformation or greed, wetin one make an investor wether newbies or veterans to invest heavily on alt or shit coin? When Bitcoin still dey in the market?
Seriously some na misinformation, and some na greed. Some people just Dey enter crypto space, and dem no really get enough information about Wetin crypto Dey about, most of them are brainwashed by people wey carry them come crypto, make dem invest in some particular shitcoins if dem Dey look for maximum profit, so I will call those ones misinformation, because they don’t really have much knowledge yet.
But you sabi people wey don Dey crypto for some time, and dem sabi Wetin crypto Dey about, den they still decide to put their money in shitcoins, then I will say that’s greed because Dey know d risk involved in it, but na d instant money wey Dey shit coins, na why dem put money be that. Because they know Dey can’t make quick money from bitcoin, so they decide to go for shitcoins.