Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The Latest Ponzi Scheme in Town, pls Avoid it.
by
Tmoonz
on 14/08/2024, 18:36:08 UTC
Mate thank you very much for this information. These scammers are bringing new new Ponzi schemes to scam people in di country. Only the registration process will make you to know that it is fake. How can some registered a business platform with only a phone number and password ? This is what they did in stepwork forward which people lost plenty money before last year.
Ponzi scheme no fit ever stop for dis our country, everybody de look for easy and fast wey to make money na y if de see Ponzi scheme, dem de believe say na legit and easy way to make sharp money, some of them know say na Ponzi scheme but de go wan enter make sharp money before e go cast. Plenty people don fall for Ponzi scheme hand but de no go still hear word, if de still see new one de go do am.

Na true talk you dey talk ooo scamming no go fit end at all and I really thank you for bringing this here, watin we need na to dey careful so as not to become a victim of being scammed, every body dey fine survival even if na scam the next person. However, the truth thing be say bad things no go fit end ooo generally but na for us to try never to become a victim of such circumstances, na to wash our eyes with hypo, clean, soap and water make our eye dey shine well well to know the things wey be scam and the things wey dey real and legit.