My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here and before you know e go twy before you see them.
So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.
As you talk am i see am well nah better discussion you bring to board so, i just see this forum be say, anyone wey you introduce to this forum as a newbie need proper orientation and guidance, e no easy for here o because you go sit down for one side dey see your friends dey cash out thinking that is easy, e no easy at all, forum self needs proper attention and can also consume person time, to get one merit self just be like you dey look for gold for dark place, I just see am say anybody wey want introduce forum for person make the pesin give am attention so that that pesin wey wan join no go lose interest.