Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Why some newbies dey quick lose interest for the forum??
by
Sexylizzy2813
on 28/08/2024, 01:34:48 UTC
I no sure say na criticism dey discourage newbies for here, na the orientation to join the forum and make money bring a lot of people come here, after you don join and e be like say progress no dey fore few weeks, you go just tire na why newbie dey pop in and pop out.
To grow profile or earn merit for here no easy and e for good if people wey dey refer people to this forum to give people better OT about am

To earn that merit na to work hard for the Forum oh, because you no go just join today con dey wait or expect the merit to fall on you like rain wey dey fall these days. Anything we do for this life e must show if we really put our mind inside and plenty effort, hard work and determination pays I no go lie you. If you carry for mind say as you enter the Forum nah to start to make moni I go tell you say that orientation you carry no go help develop your account reach anywhere, slow and steady nai dey win race and you must do something make people know you for this Forum make we no dey too expect manner to fall from anywhere make laziness no finish us oh, merit hard but make we always dey consistent.