Greetings my fellow country people, I just wan talk about this issue because na one of the questions wey I dun dey ask my sef , I dun dey reason am tey tey .
Although people the talk positively about am , them dey say e go bring about development and all that .
But wetin dey bother me naa how we go fit take avoid the negative aspects, because normally anything wey get advantage follow get disadvantage and plus this our country wey b like this so wey be say people and corruption be like 5&6 .
If we legalize this thing e fit help us oo , e fit help us well well, e fit bring about foreign investments e fit create jobs for people..
E fit stimulate our economic growth. The list plenty but make we Sha talk of the disadvantage wey e fit cos l, ike
Money laundering,
Inequality : Bitcoin fit the benefit people wey they technically savvy, people wey get money to invest and Nigeria wey I know all of this fit still resolve to corruption..
So my country people how una see this matter?
Normally e get as you wan run am wey be say somthing go just good like dat, e go get one small side wey be say e no too good for am like dat but d tin go be say if d good side beta pass d bad side and d bad side na somthing wey we fit control, den dat no go be too much mata wey be say we no go fit handle for we country and very importantly, i wan correct one impression, dat na be say no be d bitcoin be d problem, na d people wey dey wan use am go be d problem becaus if you look bitcoin on em own enh you go see say em no get wahal, na pipo na dey wan use am do bad tin, em jusst dey like tool, na wetin u use am do go determine d effect for you r side and how pipo go com take c am. if you use am well, dem go c am as good tin but if u use am wrongly e go com be like say na bad tin and na d same tin wey b say e dey help pipo grow since so na to advice country pipo make dem use am well make alll of us for fit benefit from am if dem com say dem wan finally legaize am.
Another tin u need know b say no be bticoin go bring foreign investment, e go mostly promote d ease of foreign transactons but if e happen say we no get the environment to promote foreign investments, demgo still no com even with the legalization of bitcoin just like we c with biannace dem almost comot finfis because d environmet no favour dem, but dat wan dey government hand sha.