Like this OP make we comot joke like this, if I just see 1 Bitcoin or money wey amount to 1 Bitcoin I go turn Sabinus 😅 hehe..
If I'm to be in such possession I would hold better part of it in Bitcoin and use the rest make things much comfortable for myself and family but comot joke I go flex normally, still setup one or two investment aside Bitcoin wey go dey fetch me daily living.
Everybody get their own plan but for me, as you just talk am say you go hold the better part of the bitcoin and use the remaining part chop life E no bad because even me na waiting I dey think be that but my brother if you get that kind money or 1 btc for hand my brother you go first compos yourself and how your go take spend am, you fit reason am say you wan keep some from the bitcoin but I believe say you go spend more than half of it to settle yourself and your family, with this kind hard economy wey we dey face for Nigeria so I fit sell my own all use the money start a business wey go bring profit and I will be able to buy bitcoin.
Na who belle food dey hold bitcoin, the first thing wey come your mind if that 1 btc enter your aza na to solve your problem ooh, in fact I believe say you go build house and also buy car, and you will like make you get business wey you go dey do and be able to put food on the table, although 1 btc no be small money for Nigeria now but my brother if you look at your condition you go like make you sell the btc use the money settle yourself and your family.