Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Avoid these crypto investment mistakes
by
letteredhub
on 11/09/2024, 17:47:57 UTC
•un-diversified portfolio:  this one just dey like putting all your eggs in 😂 one basket. Which means say anything way sup for that basket go affect all your eggs. So make we try to spread our investment across other reasonable assets. 
Diversification na something wey we no go fit overemphasize for when it come to investments because it dey save person on raining days. Na just as the proverb say rat way get plenty hole no dey die quick, wen one hole close na to use the another survive.

But while diversifying we get take time the do research on where and what we are diversifying out funds into, because it get certain diversification wey go lead to the investor downfall. In other words, at times it better to stay with one investment wey you dey sure of bringing you profit  than scattering your funds into different channels of investments wey no com later work. For example, it better to leave all ur funds inside bitcoin than to say you wan remove some go put for some shit altcoins wey you no even dey sure of it future