Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Invest what you can afford not what you can afford to lose:
by
Agbamoni
on 11/09/2024, 22:19:55 UTC
What you can afford is 200k, but what you can afford to invest and what you can afford to lose to investments may not actually be the same thing, not even for the same person. And I also want to believe people don't just throw their money away in gambling sites and altcoins because " they can afford to lose.
As you never get mind to lose 100k, why you go carry that kind money go invest. My people say, sew cloths according to your size, make you no go dey use another person measurements dey sew your own cloth. Another one na say, if you no fit afford something more than once make you no buy am. So that investment if you not fit afford to lose am and dey comfortable without getting depressed no do am.

@CB, you know say na yeye motivation and greed dey make some people dey use money wey dem go use buy food chop dey try luck because dem wam hit big when dem no say dem no fit afford the amount of money if dem lose amount and na why forum dey advise people every now and then say make them no because of wetin people dey talk carry money wey no be their own or amount wey go choke them go put for investment wey dem no even sure say e go work out, you don finish the whole thing, make big eyes no make people go use another person measurement sew cloth e go definitely back fire the person because is either the clothes go too tight for the person body or e go dey too loose, one word dey enough for anybody wey wam get good sense, make people leave greed e go help them to avoid heart attack.
Omor sometimes that thing no be greed o. If you know say the last card wey dey your hand if you use am buy food nothing they again and nothing you they even expect. Trying to take that kind action no go bad. Because you fit take am now, come win something wey go help dem grow pass that stage when them they. My brother the life done pass the level of just looking for weting we go put for belle. At times man need to take some kind risk fior life but not the extent of taking risk wey go affect our life or destroy us.

Sha no be say we wan invest we go con dey act blindly and foolish. E get some kind preparations and financial level wey person go they den e go make sense make him risk for investment. No be say person still dey on dead zone and him they use the little money him suppose use dey guide ey go invest. If he come sick now where him go see money to use treat himself if no be to collect the money him put for investment. Now imagine say the investment at that time con they on loss. E mean say him done lose big time be that na.