Bitcoin na one of di best investments wey anybody fit to enter but many newbies no know say e de better to hodl am for long term. Unto say Bitcoin de volatile dat na why e de advisable to hodl am for long term because na store of value wey de take long term to reach new ATH price and give better ROI.
But I don notice say many newbies wey I know for Bitcoin matter no get knowledge about how e de work, dem de buy Bitcoin with money wey dem wan use on the short term because dem hear say e de profitable. I believe say na only wen we enter bull run proper wey Bitcoin price go de surge steadily na im investors fit to take chances to invest money for short term profits.
The earlier wey newbies understand say volatility na the nature of Bitcoin, the better for them else them go continue to dey mistakes with their investment plan all in the name of volatility. For person to consider Bitcoin as a store of value, you must think of long-term and I done see say that na wetin some investors now understand, that's why dem go rush sell their holdings whenever price drop. I done also notice say why many investors dey panic sale when price drop na because of say dem dey go into Bitcoin investment with too much emotions, to become a Bitcoin investor you must kill your emotions, overlook pressure from the market (volatility) then get patience since Bitcoin investment na for long-term goal. Na true you talk say many newbies no get proper knowledge about Bitcoin before they invest and most of them rush into the market due to influence from the media or desperation to make quick money though Bitcoin, without making proper findings about wetin them dey do, that's why them dey reason short-term instead of the other way round.