Wuna good morning oo! I just wake up this morning hear say Seyi Tinubu and Yinka Tinubu paid a condolence visit to those affected by the flood in Maiduguri and have teamed up with the Noella Foundation, and various private sector collaborators to gather substantial humanitarian assistance for the victims. Shey Dey wan use this flood thing Dey campaign for 2027 ?
Me I no see anything wey bad for d visit, and I no see anything wey bad for d donation, na still from our money wey dem steal na him dem Dey use do donation. But I never even know how people wey Dey dis country go take survive till 2027, because d kin hunger wey Dey dis country now, I no fit just talk am. But na crazy people go still campaign and vote for tinubu 2027, seriously anybody wey we catch wey Dey campaign for am, we suppose fire am beating maybe d person go get sense, because person wey Dey him right senses no go even vote or campaign for tinubu again.