Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: DCA NA THE BEST STRATEGY FOR NEWBIE IN ACCUMULATING BITCOIN
by
CryptopreneurBrainboss
on 22/09/2024, 22:20:05 UTC
DCA no be only for newbies but na for everybody, DCA good make we all dey do am and not to buy Bitcoin at a go. No be say that strategy no make sense but DCA make sense pass am because of some of the advantages of DCA. DCA go protect you from so many things like market volatility and you done talk them so I no need to repeat things again.

lastly, in order for not to trade ur bitcoin at the early stage of your investment, you need to dey set aside some money( emergency fund) bcos nobody fit predict the future, you fit get some problem wey go want pressure u to trade your bitcoin when the time never reach for you to trade. this money will help u not to trade your bitcoin before the expected time.

Invest only wetin you fit afford to lose and money wey you no go need for long time because things they happen wey go make you need money urgently.

Them say as you dey hustle, try dey keep money for problem because problem no they finish so if you wan invest, also keep money for problem or you go use your investments solve your problem. The problem no be to invest but you go fit hodl. I dey see people accumulate Bitcoin finish but problem go come carry all because them no plan for problem (raining days).