Sport betting have really changed the lives of many individual and have also leed most people to poverty in Nigeria am a victim also at first you will be benefiting from it thinking that you will be winning every Day.
Na d mindset wey you carry go gambling, na Wetin go determine if you go regret later if you keep on gambling or not. If you put am for mind say you wan Dey make money from betting, or you carry am like your source of income, dem you no fit avoid am, last last na regret go end am, because even when you suppose to stop betting, you no go stop just because of the money wey you Dey pursue, nothing wey anybody go tell you that time wey you go listen, till you don lose everything before eye go clear, and some go don Dey sell their properties self just to bet.
Am advising any one who is involved into sport betting to avoid it now it's not good for you please
If you Dey bet just for fun, me I no see anything wey bad for that one ooo, because anybody wey Dey bet for fun, na just small money wey him know say even if him lose, e no go too affect am na him d person go put, but if you don go put big money, na where problem Dey start be that.