Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: DCA NA THE BEST STRATEGY FOR NEWBIE IN ACCUMULATING BITCOIN
by
Samlucky O
on 26/09/2024, 18:26:53 UTC
DCA Na the best strategy for newbie to be able to accumulate enough bitcoin. As newbie wey never get idea about bitcoin, this method is less stressful compare to other method. In this method you no need to time the market before you  buy, all you need Na to ready your money ,make plans how you want take dey invest your money, weda Na weekly or monthly basis. Depending on how your income take they come. You go also plan how long u want hold the bitcoin bcos this method no be watin u want do for months, Na year matter be this, like 5_yrs or more depending on ur plan.
Normally DCA strategy na for both newbie and the old investors no be for only some set of people. DCA Na the easier and best way to invest with ease, without much stress. The only challenge be say person need to get work wey E go dey do, sothat E fit dey invest for bitcoin. To invest for bitcoin need make person dey constant like to duty yourself say any money wey enter your hand you go try put some percentage for bitcoin for long as say you dey get steady money. But the problem be say if you no get work again base on how the country be, person no fit get that patient to HODl.

DCA no be for people wey want make quick gain , so if u no fit get patience this method is not for you. why I said this method is best for newbie, be say as a newbie wey never get much idea about bitcoin to go do lump sum fear go dey your body as newbie but with DCA you will be buying the bitcoin small, small until u done get enough for ur portfolio.
The aspect you talk say newbie go fear to buy lump sum, me I talk say na lie. Person fit be newbie for this bitcoin matter but no means say money no dey. Some newbie self get money to invest but them just need Orientation for where dem go invest. If the  person teach them the right way to invest, them go do well but where fear go catch dem na when dem no get person wey go guide them.