Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Last last na patience win am
by
Nangiconference
on 26/09/2024, 21:28:42 UTC
Atleast dem try reward small token for the effort. The money fit small but e mean a lot to many for this economy. Omoor, if to say the thing b turn out good, I for vex for myself, because I get equal chance to participate but I been no care. My instinct just no permit me to follow up. I no mine reach one week, I just tire.
I come Dy wonder say where the founders go get this kind money from pay all the participants because since I Dy hear of airdrops, no one reach hamster. Papa o, mama o, pikin o, follow for the competition to the extent some people create 2 and more accounts. Anyway God no go fail us. Bitcoin na Bitcoin. Na bitcoin lay the standard for others to follow, na this same mining dem do for bitcoin till dem launch am.