Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: U dey use Bitcoin dey purchase or just investment sake
by
Brainiac01
on 28/10/2024, 21:28:01 UTC
Weting anbodi wan use bitcoin do na him own gbalaba because bitcoin they easy to use when person one buy something and many people wey get money they use am too store their value. As for me, i no get anything wey i wan really they purchase online wey ah go need bitcoin sha. Even for the gamble wey ah they do, i no dey deposit bitcoin because of the transaction fee cost. Anyway the only thing wey i know say i get with bitcoin na my investment. Even if the investment na small small money ah they out iniside bitcoin i just believe say e better pass person wey no they put anything. Weting ah done learn for the forum be say, e no they about weting we get now for bitcoin (like the value of our bitcoin) but by weting e go be for future. E better say i get hope on something in the future than say ah they live to please and satisfy myself now. E no go make sense say after everything we done learn for here we come regret later why we no invest for bitcoin.