Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: BSC deposit and VAT fee
by
Davidvictorson
on 30/10/2024, 05:57:43 UTC
Na why wetin Kucoin dey do nor make sense to me. With all the taxes wey dem dey charge Nigerians because of dis owa bulaba government, dem still nor allow us do P2P. What's the essence then? So, if I transfer to dem and make money from trading I go still need to find an external P2P to get my fiat. E nor make sense at all. Kucoin na d second account wey I open after Binance in 2017 because then e just dey copy everythin wey Binance dey do before Binance went real tech, come leave am behind. I nor dey do any active trading on Kucoin again since I noticed dat nonsense.
This one na him dey burst my brain pass. We nigerians no dey complain, collect your VAT and restore the P2P. We go pay instead of trying to rip us. Abi dem dey vext say our government make them lose money and now dem one get am back before them go open up their P2P? Well the whole thing nor make sense. We nor fit even talk about Binance because our government don already do dem dirty. So those ones go take long before dem go look our side again. Na just the anyhowness of the government cause all these wahala sha.