Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: am i doing something wrong
by
Fiatless
on 01/11/2024, 09:37:11 UTC
good day my brothers and sisters im very sorry i created this thread here but i dey fear say if i put am outside i go receive plenty backlash person wey tell me about the forum tell me say na so dem dey do there
But i just wan beg for una advice i know say i never stay long for the forum but according to what i read i will receive merits if i create quality post i have been doing just that since i entered this forum or are my posts not meeting the standards of the forum please if you can please enlighten me if im doing something wrong
thank  you for your time
Baba I done check your post dem, you dey try wella but there is still room for improvement. But you just dey one month for the forum and you never learn plenty things. No give up oh, merit go come as you dey learn more and contribute to the forum. If you rush to get am you fit enter one chance. So I go advise say make you take am easy and no just focus on merit. Some niggers wey I invite come dis place takeoff (run) after few months because dem no get merit. But most people wey dey hear patiently wait for many months before dem get merit. But I dey assure say if you take time do research before you post merit go come. Still on still make I still be the first to shower you with one brotherly hug. I just want motivate you to keep pushing, so no fall my hand. No give up because you fit regret later if you throw in the towel. One love brotherly.