Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Tell us the biggest thing way bitcoin don do to u dis year
by
Fiatless
on 02/11/2024, 11:43:29 UTC
Dear Good members of the Bitcoin Forum,
With December just around the corner, it is opportune time to talk about how bitcoin has impacted our lives. For instance, how do you feel that bitcoin has changed or impacted your life the most in this present year?

Some people go wan keep their investment or experience this year on code because of privacy.

For me, my experience no dey different from most Nigerian Bitcoiner. I bin dey hope say my salary for work go dey enough for me to survive and still save some money to you buy Bitcoin. But immediately Bola Tinunbu enter government na so my plan scatter. As the price of things come high, I no fit save money again. Now my plan na to survive, no bi to even save money from my salary again. Buy any how we still dey struggle to invest.  

Quote
Self-development or educational achievements
For these two points wey you mention, na bitcointalk dey help me oh. All the information wey I need to learn more things about cryptocurrency dey for this forum. The achievement wey I get bi say I don learn more things about economics and investments.

Quote
Active participation in communities or meeting new people
Na only this forum bi the crypto community wey I dey active. The year never end, I still dey hope to meet new and resourceful people.