Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Question about the new P2P option
by
Spaceman1000$
on 16/11/2024, 14:16:11 UTC
I just notice say for Bybit some vendors they specify say there payment method nah cash in hand, abeg anybody don try out this option here ?

With the kind security issue we they face for this country that kind deal no be Watin person suppose even agree to do in the first place, as I we don see for general board where such deal almost lead to something else.

I just wan ask if anybody don make use of that option before and also to warn against the danger of such deal..

I never try this option before Shaa, but e dey me surprising as I never see this kind thing before, assuming say I agree for the cash in person, but the person way be vendor dey Abuja and i come Enugu, how we wan come take run the deal since we no dey the same city. Baba the P2P way involve the one way u no Sabi me and I no Sabi you nai be the best oh, just TF me my money make I give you the coin without us knowing eachother, as this country dey, the risk dey too much to come do money business with person on a physical ground when you no sabi am from adams.